published on in Celeb Gist

Matthew Perry: Who be di Friends star wey act Chandler Bing wey die at 54?

29 October 2023

American actor Matthew Perry, wey dey most popularly known as Chandler Big for di hit 90s TV sitcom, Friends don die at di age of 54.

Law enforcement tell US media say dem find di actor dead for im house for Los Angeles.

Friends wey dey about six young friends wey dey live for New York City, bin dey on air from 1994 until 2004.

Im last episode bin dey watched by 52.5 million for US wey make am di most TV episode for di 2000s.

Di LA Times and TMZ wey first report say Perry don die say dem find di actor for im hot tub unresponsive.

Los Angeles Fire Department tok-tok pesin bin BBC say di first responders bin go one address for di Pacific Palisades area, sake of one "water emergency" wey dem no sabi di type, but dem no mention Perry name..

Tributes for Matthew Perry

Warner Bros TV wey bin produce Friends tok say, "we dey devastated by di passing of our dear friend, Matthew Perry."

"Pipo around di world bin feel di impact of im comedic genius and im legacy go live on for di hearts of so many. Dis na heartbreaking day, and we send our love to im family, im loved ones, and all all of im devoted fans."

Warner Bros, wey produce di long-running series wey don see new audiences through global reruns wey di new generations of viewers don watch, describe Perry as a "true gift to us all".

Entertainment reporter Sean Mandell describe di overwhelming feeling for Los Angeles as "shock" and a "ubiquitous response" as many pipo no believe say Perry don die.

E tell BBC News say, Perry bin play ogbonge part for di success of Friends and na pesin wey dey "for di hub of di wheel".

"Im character na di perfect combination of whit, but also true heart and e dey grounded," e tok.

Maggie Wheeler, wey bin play di role of Chandler troublesome ex-girlfriend Janice for Friends, na di first of Perry co-stars to publicly pay tribute to di actor.

Wheeler tok say di joy Perry bing to "so many" for im "too short lifetime go live on".

Morgan Fairchild wey bin play di role of Perry on-screen mother and erotic novel writer Nora Bing, tok say: "I dey heartbroken about di untimely death of my 'son', Matthew Perry."

"Di loss of such a brilliant young actor na shock," she add.

Cruel Intentions actress Selma Blair tok say Perry na her "oldest boy friend", she add say: "All of us loved Matthew Perry, and I did especially. Every day. I loved am unconditionally. And he me.

"And I dey broken. Broken hearted. Sweet dreams Matty. Sweet dreams."

Who be Matthew Perry?

Dem born Perry for Massachusetts for 1969. E grow up for Ottawa, Canada wia e go school wit Justin Trudeau, wey later become di kontri prime minister.

Canadian Prime Minister Justin Trudeau, bin write on X: "Matthew Perry passing dey shocking and saddening. I no go ever forget di schoolyard games we used to play, and I know say pipo around di world no go ever forget di joy carry bring dem. Thanks for all dilaughs, Matthew. You were loved - and you go dey missed."

Perry come move to Los Angeles as teenager to work as actor. E feature f as Chazz Russell for Boys Will Be Boys and e also get roles for shows wey include Growing Pains.

But e become international star on Friends, one show wey bin follow di lives of six New Yorkers wey dey navigate dating, careers and friendship.

Di comedy, bin co-star Jennifer Aniston, Courteney Cox, David Schwimmer, Matt LeBlanc and Lisa Kudrow, e become one of di most successful shows of all time.

Dem cast Perry as di awkward Chandler Bing, e dey popular for im sarcastic one-liners. Di role earn am Primetime Emmy nomination for 2002.

Afta di show wrap for 2004, e act for anoda popular feem wey dem dey call di The Ron Clark Story for 2006 about how one man become teacher for pikin dem di school system don give up on and how e make dem to start to dey value school.

Di movie bin bring up di Presidential Rap wey don become common tropes for many shows like Family Guy.

Perry bin battle addiction to painkillers and alcohol for years and e go rehab centres for multiple occasions.

For 2016, e tell BBC Radio 2 say im no remember three years of filming of Friends because of drink and drugs.

For one interview last year, he tok say im no watch di show.

E say, "I no watch di show because I fit go, 'Drinking, opiates, drinking, cocaine'. I fit tell season by season by how I look. Na why I no watch am because na wetin I dey see. But I tink say I go start to watch am because na ogbonge tin to watch am see wetin touch di hearts of many generations."

Perry also show for plenti feems including Fools Rush In, Almost Heroes and di Whole Nine Yards.

Im most recent role na as Ted Keneddy wey be former US senator and di broda of di assassinated president John F. Kennedy for di 2017 TV mini series wey dem dey call The Kennedys: Decline and Fall.

Im final significant TV project – apart from di Friends reunion – na one TV reboot of The Odd Couple, wey bin last on American screens for three seasons.

Im final Instagram post, wey e publish few days ago, show as e dey relax for di rooftop of one pool. Di post don attract plenty tributes from fans.

Perry leave parents John Bennett Perry and Suzanne Perry, wey separate wen e be baby. E get five half-siblings.

E no ever marry and e no get children.

Perry tok say im dey inspired by im father, wey also be actor and bin appear for one episode of Friends for 1997 as Mr Bergin, di papa of Rachel love interest Josh.

ncG1vNJzZmivp6x7o67CZ5qopV%2BltqWzyKdmmqqknrCtsdJomrBxpmm3ccPLbqmo